Tales of two funny ritualist - Season 1 - Episode 22

Episode 6 years ago

Tales of two funny ritualist - Season 1 - Episode 22

continues from the last episode.

Flex: brother I beg just pity am.



Me:
brother pity me abeg, I swear I no go do am again, you know say na you be boss, after you na you.

Talent scout: I just dey pity you..
Me: thank you..

Talent scout: I for just break your neck now, nonsense, get out of my side jare.

Me: thank you very much. I appreciate it sir.

Just then, victoriouschild came out from her room holding a bucket, she was going to the bore hole to fetch water when she saw us and turned.

Victoriouschild: haa, this one wey una dey hear wetin dey happen?

She hadn’t finish her statement when the rest beautiful babes, jummybabe, soma and denncygirl all came out.

I dey craze to fall my hands for the beautiful babes front, I quickly reacted.


Me:
no mind am abeg. Nothing much dey happen.

Talent scout: no waste your time for here vicky, go fetch your water abeg. Leave this boy he’s not man enough, since he dey beg.

Me: if you know say dem born you well repeat that statement again.

Victoriouschild: haa, una won start again.

Me: nooo, victorious..victorious…victorious abeg wetin be the suffix again?

Victoriouschild: child.

Me: thank you, victoriouschild leave this idiot, person wey I want tear into two before you come.

Denncygirl: en enhhh, tell me something.

Me: ask flex, I be one tear the idiot slap since I just dey pity am.

Talent scout: Jesus you say wetin?

Me: you see, na Jesus you dey ask or na me.

Talent scout: like say you dey mad!!


Me:
if you repeat that statement again thunder go fire you.

Talent scout: me!! In fact make we fight.

He said and tore of his cloth into two effortlessly.


Me:
iyeee, tenants!!!!! Make una come hold person pikin before I kill am oo.


Me:
donflex hold that guy, hold that guy before I deaf deaf am with slap.

Just then, froshberry and konami came out.

Froshberry: wetin be all these again?

Konami : I tire oo, make we go hold talent scout before he kill the new tenant.

They said and held him just in time before he will give me my first and last superman punch on this earth.


Me:
why una dey hold am? Leave am make we fight make I doom doom am abeg. I dey vex, I dey vex I swear. Leave am make I doom doom the idiot, leave am oo leave am!

Konami: you say wetin?
..
..
..
..

Previous Episode

Tales Of Two Funny Ritualist - Season 1 - Episode 21

Next Episode

Tales Of Two Funny Ritualist - Season 1 - Episode 23

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)