Tales of two funny ritualist - Season 1 - Episode 20

Episode 6 years ago

Tales of two funny ritualist - Season 1 - Episode 20

Talent scout: ee be like say una too like trouble well well.

Me: shut up, you no know wetin you dey talk abeg.

Talent scout: make me I shut up?


Me:
no, make your mama shut up. You just get luck say I sit down here with my church mind or else, I for don dash dash you heavy heavy slaps since.


Talent scout:
meeeeee!!!!!!!!!!!


Oga val:
ee don doo. Na wetin I know like be that o. I know like fight for my compound and anybody wey break the rules go pay fine, una hear me.

All: yes sir we don hear.


Oga val:
oya ladies,, introduce una self.
One fine young lady stand up.

Lady: my name na victorious child.
I look Donflex and Donflex look me, we start to laugh like mad men. Na which kind house be this self?

First the name of the compound na HOUSE OF COOLVALLERS, second the name of landlord na Oga val, third the tenants dey bear names like say world won end.

From froshberry (berry wey dey frosh) to Frankay ( e dey a little bit manageable but your mama no put Kay when she dey dedicate you) to Konami (the name of gameboy, pes 1, 2 or 3) to Talent scout (na he own name break record, talent wey dey scout)
we think say the women go come up with nice nice names but to my greatest surprise, one big, very big fine lady say her name na victorious child, I just dey wonder when dey born her newly. Maybe from the womb she dey answer victorious pikin, now she don grow to adult stage na Victorious child, when she marry na victorious teenager, dey when she don old like ninety nine years ee go be victorious adult. But the lady just fine well well, na her name just dey somehow abeg..

Victorious child: na my name una dey laugh.

Me: no o, we dey craze?

Donflex: na my own name we dey laugh, my village name.

Victorious child: better.

She said and sat down. The next girl, oh My god, the next beautiful girl sitting besides her stood up, oh men she fine die!


Girl:
call me denncygirl.


Me:
** I talk am, you no see angel to bear, Tracy or Sandra to bear. Na dancing girl you go bear**
I said in my mind.


Donflex:
** you get luck say you too fine if not i for call you makossa girl not dancing girl**
he said in his mind. Since the girl too fine, we no fit insult her so she sit down. The last name we heard was very better, her name is soma but I still dey wonder…… make I shut up first.

After the introduction, we payed our house rent and went separate ways. Welcome to house of coolvallers. Welcome to the house of magnificent names!!!
..
..

Previous Episode

Tales Of Two Funny Ritualist - Season 1 - Episode 19

Next Episode

Tales Of Two Funny Ritualist - Season 1 - Episode 21

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)