Tales of two funny ritualist - Season 1 - Episode 19

Episode 6 years ago

Tales of two funny ritualist - Season 1 - Episode 19

Me and Flex entered inside our new house.

Me: that girl is really friendly o.


Flex:
yes she is.

Me: but me self won come f--k up.


Flex:
no be say you self won come f--k up. You don already f--k up.


Me:
how, you know see say she don already forgive me.

Flex: yes o, you are right. She don already forgive you.

Me: so na how he go be?


Flex:
I no understand you again o.


Me:
about the girl jummybabe. He be like say I like her o.

Flex: you dey craze, thunder fire you.



Me:
na wetin I do again na.


Flex:
you dey stupid for asking that question.

Me: see, you better stop to dey insult me before I tear you slap o.

Flex: try am if you fit. Girl wey go be my girlfriend na im you won go chike?


Me:
girlfriend? How?


Flex:
you no know say na her I book as my girlfriend?

Me: hahahahaha. You don book girl wey never agree to date you.

Flex: ah, na now I know say you no get eye.


Me:
why you say so?


Flex:
you know see say she don already fall in love with me?

Me: tarh, make I shi.t egg.

Flex: and u go shi.t the egg.

Me: na me she like no be you.


Flex:
you wey dey fear her. Lol, abeg go sitdown for one place jare.


Me:
ok, make we bet first to get her.

Flex: no problem, make we do.
*****************************
NEXT DAY…


we were in a meeting, tenants and landlord meeting.


Oga val:
my tenants, I greet una o.

All tenants: landlord we dey hail oo.

Oga Val: una know the reason why I call this meeting?

Tenants: no sir, please tell us abeg.

Oga Val: we don get new tenants for here, so we can go kindly introduce ourselves to them while them too go introduce themselves to us.

Me: My name na Idris.


Flex:
my name na Donflex but you can call me Flex.

Oga Val: na me be the landlord val.


Man 1:
welcome my name na froshberry.


Man 2:
welcome I be Konami.


Man 3:
una welcome I be frankay


Man 4:
welcome I be Talent scout.

Me and Donflex: Hahhahahahah, how manage your talent dey scout?

All: hahahaha, nonsense guys.
*
*
*

Previous Episode

Tales Of Two Funny Ritualist - Season 1 - Episode 18

Next Episode

Tales Of Two Funny Ritualist - Season 1 - Episode 20

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)