Tales of two funny ritualist - Season 1 - Episode 10

Episode 6 years ago

Tales of two funny ritualist - Season 1 - Episode 10

Me and Donflex quickly walked over to the shop she was about to enter. We stood at the entrance and waited for her to come out. It wasn’t long when she came out with a packet of cigar in her hand.

Donflex: ohh, so oloshi dey smoke?

Me: and on Sunday them go wear white and black go church. Them go dey form like say dem no dey s--t.

Girl: una two don come again abi.

Flex: shut up, you dey mad.


Me:
thunder fire your papa.

Killer: na my babe this guys dey shout for? Arrow!

Arrow: sir!

Killer: go bring plank come.


Arrow:
yes sir.

Girl: abeg make una run o.


Flex:
why, you no want make we see you dey smoke abi?

Me: for that reason you are very very stupid.

Girl: my boyfriend killer dey come oo. Abeg run.

Flex: hahaha. Killer no be name of dogs. I know, I know say your boyfriend na dog he be. Me as I dey so,
unknown to him, Killer was standing at his back. Luckily for me, immediately the girl mentioned that her boyfriend is coming, I turned back and lo and behold, she was saying the truth.

Two guys were approaching us with heavy heavy planks. Mumu donflex didn’t see them as he was still busy lashing insults on the poor girl.

I never knew how I did it but when I saw the guys approaching us, In a twinkle of an eye, I was already fifteen kilometres away from the scene.


Flex:
me as I dey so, I no dey fear. I go dey here till you smoke finish. I must make sure I snap you, carry am go give pastor. Sheybe na you dey claim say you be report card.

Girl: *shakes her head in pity*


Flex:
who you dey do that one for?

Girl: just turn back, today my boyfriend go kill you.

Flex: hahaha. If na true you dey talk make I shi.t egg, I swear to God no lie you lie so. Say your boyfriend killer abi na savior fit beat me? If na true make I lay three eggs right now.

A hand touched him at his shoulder. He couldn’t turn. The strength and impact of the hand alone was as if six men were holding him.


Killer:
oya, get ready to dey sh.it the egg.
He slowly turned and saw two rough looking, heavy muscles guy. Just like David Otanga, or Riback or even Baptista that do fight wrestling standing before him.

Me: **shouting from fifteen kilometres away** FLEX, YOU CAN DEFEAT THEM, I AM SOLIDLY BEHIND YOU!!!

Killer:
so I send my babe go buy cigar for me you dey block her abi?

Flex: I dey craze? I dey mad? I just dey check the expiring date of the cigar.

Killer: so na who you be? In fact where that your other friend wey dey follow you dey shout for her.


Me:
** from fifteen kilometres away ** THE TWO OF UNA DEY MAD. UNA DEY CRAZE. UNA NO KNOW SAY THE BOY WERE UNA HOLD SO NA FIGHTER HIM BE? FLEX GO BEAT ALL OF UNA HANDS DOWN. UNA GET LUCK SAY I DEY FAR AWAY FROM THEIR IF NOT I GO CHOP UNA FATHERS!!!!

I shouted from a safe distance.

[B] Killer:
shoo, na me your friend dey pour charge on?

Flex: I swear to God Jehovah El-shadi, the alpha and omega. I no know that boy. In fact look am, you go no say na psychiatric hospital him escape from.

Girl: for where? Na best friends dem be. Na dem dey share my ynash for church?


Flex:
mogbe!!

.

Previous Episode

Tales Of Two Funny Ritualist - Season 1 - Episode 9

Next Episode

Tales Of Two Funny Ritualist - Season 1 - Episode 11

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes


Related episodes
Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 2

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

Skinny Girl in Transit Season 1 Episode 1

My Flatmates Season 1 Episode 1
episode | 5 years ago

My Flatmates Season 1 Episode 1

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)
episode | 6 years ago

TV Series: Professor Johnbull Season 4, Episode 2 (Campus Marriage)